Thursday, July 14, 2016

Chelsea don sho dia niu manija Conte to niuz pipul

Chelsea don sho dia niu manija, Antonio Conte to wold niuz pipul on Thursday aftanun. Conte yuz di okeshon we hapun fo West Stand insaid Stamford Bridge to du im fest pres konfrens as di Blues koch.

Conte tok se im de luk ahed and im go mek shuo se di Blues go stat to chalenj fo taitul agen and ple fo Champions League.

"Mai bele de swit se a de stat niu sizin wit Chelsea. Na niu shapta fo mai laif, fo mai kariya, fo mi and fo mai famili.

"A de hapi to stat wok fo korekt kontri wit korekt "league". Dis na di most difikolt "league" fo di hol wold bikos i get laik 6 ou 7 klob we fit win di taitul. Chelsea na big klob and a de praud to bi dia niu koch." Na so Conte tok.

Conte tel pres pipul say John Terry na impotant pleya fo Chelsea and im go stil rimen kaptin.

"Im na di kaptin of dis klob. Na big pleya wit big pesonaliti and swaga. A de laik to tok wit am bikos im sabi wetin yu nid to ple fo dis klob. Fo mi, im na impotant pleya.

"Ol di pleya dem nou se na fo trenin a de selet mai fest 11. If eni pleya disav to ple, im go ple. John Terry na kaptin of Chelsea weda im de ple ou im no de ple. Im bi kaptin olwes.

"Im na impotant pleya fo mi, di klob and di fans dem. Im bin sain niu kontrakt fo May bot na mi and di klob join bodi tek di disishon. A de hapi se John Terry sain niu dil wit Chelsea. A don tok wit am meni taims, and di tin we de impotant pas bi se im de hapi wen im sain."

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories