Wednesday, July 13, 2016

Chei, si moni! Tif abandon bank N60m fo supamaket ron

Na N60,250,000 yu de si so, and na Rivers State Police Command rikova am fo Everyday Supermarket, Port Harcourt wia di tif abandon di moni faind im levul.

I rili sopraiz pipul on Friday wen niuz bigin waka se won bulion van we kari mou dan N100m don miss.

Si wetin DCP Uche Anozia tok abaut hau dem manej faind di moni.

“Wi get infomeshon on July 11, se dem pak won Ford Explorer fo Everyday Supermarket wit big big sak we bi laik se na bank get am.

“Na im a send mai DC Operations to di eria to tochlait di moto. Wi kom get lok se di sak we de insaid di moto na Stanbic Bank oun.

“Di infomeshon we a hie bi se di moni we de insaid na N60,250,000. Di draiva we pak di moto de wok fo Everyday Supermarket, bot im don ron."

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories