Di Acting Inspector General of Police, Ibrahim Idris and di Director-General of Department of State Services, DSS, Alhaji. Musa Daura bin arenj mitin yestade bikos of di sinetorial and Haus of Asembli elekshon we INEC wn du fo Rivers Stet.
Wetin dem tok fo di mitin na hau dem go manej to du di elekshon we faitin and kilin no go de.
Di tu pipul fo Rivers Stet we bi se dem and dia sopotas no de tek ai si ish oda, Govano Nyesom Wike and Minista Rotimi Amaechi bin de fo di mitin.
Si hau dis tu pipul we no de setul at ol at ol kom manej shek ish oda hand fo piksho.
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.