Thursday, July 14, 2016

Aisha Buhari "fraud" :Fayose de lai - US govament

US govament say dat tin we Govano Ayodele Fayose of Ekiti Stet tok abaut Aisha Buhari na lai o.

Fayose bin tok se Baba Buhari waif we bi Aisha get hand insaid won wuru wuru biznes we hapun som yiez ego. Im kom ivun kwot se na fo pej 22 dem menshon Aisha Buhari nem fo court jojment insaid di biznes we no "pure".

Nau di US govament de tok se dem no get eni evidens se Aisha bin get hand fo eni kona kona biznes fo dia kontri.

Acting Public Affairs Officer, US Consulate General, Lagos, Frank Sellin tel Punch say dem no get eni infomeshon about Aisha and eni wayo biznes.

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories