Di Actors Guild of Nigeria, AGN and di Performing Musicians Association of Nigeria, PMAN tok say iroko don fol fo entatenment indostri as old taim aktres Bukky Ajayi don dai.
On Wednesday monin na im Bukky Ajayi kari waka go join ha ansestos at di ej of 82 yiez.
Mr Agility Onwura we bi AGN chaiman fo Abuja say wetin de pen am bi se Ajayi dai di taim we di yong yong wons stil de len from am.
Hie wetin Onwura tok.
"Di tin sopraiz mi as hie se shi dai o.
"Shi dai wen di yonga aktos stil de len from ha plenti ekspiriens.
"Yu fit tok say pesin we rich 82 yiez don trai, bot fo di entatenment indostri, wi stil de len from am."
Pretty Okafor, National President of PMAN se im no fit foget ol di beta tins we Bukky Ajayi du fo Nollywood and di hol entatenment indostri fo Naija.
"Shi bi orijinal profeshonal we jinja os wit ha korekt aktin fo meni hom vidio dem.
"As shi don waka so, ol di entatenment indostri go stil de rimemba am."
Okafor say wai dem no go kari tu moch bi se Bukky Ajayi liv beta laif we plenti pipul bin len somtin from.
"Wi sopoz to selebret ha laif and achivment dem bikos to rich 82 yiez no bi smol tin."
Dis Ajayi we dai so don de akt fim sins naintin sevunti somtin.
Shi bin akt fo Village Headmaster, Checkmate and plenti hom vidio dem.
Ajayi olso bin rid niuz fo Nigerian Television Authority, NTA.
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.