Friday, June 17, 2016

Si di 3 law meka we enta minimini wanawana wahala fo America

Una go don hie se 10 of awa Honorebul memba fo Haus of Rep go trenin fo USA.

As dem de du di trenin de go, na im 3 of dem go de faind anoda tin fo kona.

Akodin to di leta we di US Ambassador to Naija we bi James Entwistle bin rait giv Hon Speaker Yakubu Dogara, wan of dis legislato dem bin wan du bai fos minimini wanawana wit hotel attendant.

Di oda 2 legislato dem, akodin to di leta, bin go mit som hotel staf mek dem arenj som wumen fo dem onto minimini wanawana levul.

Enihau, dis legisleto dem don de shaut am on top mauntin se dia hand no toch oyel o. Dat wan min se di Ambassador de lai.

Eniwe, as di Haus de tochlait di mata, mek wi sef de wan kona de luk dia fes.

1. Hon. Samuel Okon Ikon (PDP, Akwa Ibom). Im de riprezent Etinan/Nsit Ibom/Nsit Ubium Federal Constituency.

2. Hon. Mohammed Gololo (APC, Bauchi). Im de riprezent Gamawa Federal Constituency.

3. Mark Gbillah (APC, Benue). Im de riprezent Gwer East/Gwer West Federal Constituency.

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories