Col Charles Nengite of Nigerian Army ova dis wikend we jos pas tia 38 yiez rekod fo USA War College, Carlisle, Pennsylvania as im top 380 oda postgraduate students.
Infomeshon we dem put fo di kolej websait sho se wetin Charles du na di best performance fo eni forin student fo 38 yiez.
Insaid the achivment we dis Naija soja mek na; A Distinguished Graduate award we dem de giv di top five fellows fo di class of 381 pipul; di Commandant’s award fo distinction in research; di USAWC recognition award fo innovation in SHARP – Sexual Harassment and Response Programme and articulated a seminal paper – “I am your friend campaign’’ – strategy under the SHARP and olso di 2nd best speaker award in the speaking competition in the 2016 klas we bi se na 302 Americans and 79 oda nationals from 73 oda kontri dem.
Naija Languej de say kongratuleshon to dis korekt Naija pikin we go sho dem fo America se wi no de dol fo Naija.
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.