Wednesday, June 22, 2016

Fayose don enta N4.7b arms moni wahala

Di Economic and Financial Crimes Commission, EFCC don tok se Ekiti Stet Govano, Ayodele Fayose and bifo bifo Minista of Stet fo Difens, Musiliu Obanikoro bin kolekt N4.745bn from di arms moni we som pipul bin folo bakyad kari.

Akodin to EFCC, dem put N4.745bn into di Diamond Bank akaunt of Sylvan McNamara, wan kompeni we bi se na Obanikoro im sons Gbolahan Obanikoro and Babajide Obanikoro bi signetri dia.

Naija Languej hie se na November 2011 dem rejista dis Sylvan McNamara and na Ikenna Ezekwe, Idowu Oshodi and Elizabeth Adeniyi bi di dairekto.

EFCC say dem don friz di akaunt of Govano Ayodele Fayose and Sylvan McNamara we bi se na Obanikoro pikin dem de ron tins dia bikos dem diskova som kain kona kona biznes dia.

EFCC olso tok hau N1, 219, 490,000 bin folo aeroplane go mit Fayose fo Akure Airport on June 12, 2014 tru im man Abiodun Agbele (aka Abbey).

Si wetin EFCC rait fo dia ripot.

“On June 12, 2014, laik 10 dez to  Ekiti Stet govanoship elekshon, Obanikoro and wan man we poz laik ADC (im nem na A O Adewale) bin chata wan praivet jet from OAS Helicopters.

“Somtin laik N724,500,000 na im di plane wit tail nomba N638MA kari . Di plane na HS125 jet we Okin Travellers, a branch of Elizade de opret. Di plane bin land fo Akure at 9.38am. Im kom flai bak to Lagos go bring ekstra N494,900,000 kom land fo Akure bai 5.57pm.

“Obanikoro kari di moni giv wan Abiodun Agbele, aka Abey we bi Fayose padi man. Zenith Bank ofishal dem bring bulion van fo tarmac, we dem yuz kari di moni go dia bank fo13 Alagbaka Estate, Akure.

“Abbey dairek di bank to put N137m into Ayodele Fayose akaunt wit nomba 1003126654 and Bank Verification Nomba 22338867502. Di bank teller det na June 26, 2014, and na Abbey fil am wit teller nomba 0556814.

“Abbey kom tel di bank to transfa N118,760,000 to di sem akaunt. Afta dat wan, im kom stil pe N50m kash insaid Fayose akaunt.

“Fo April 7, 2015, afta som mont, Fayose bai imsef kom muv N300m to im fiks deposit akaunt fo Zenith Bank wit nomba 9013074033 wit di sem BVN. Di akaunt de fo 15 Olusola Abiona Street, Alapere, Ketu, Lagos.”

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories