Sunday, June 19, 2016

Boko Haram kil 7 polis fo Niger Ripoblik

Islamist terrorist pipul we dia nem bi Boko Haram don go kil 7 polis ofisa fo Niger Ripoblik o. Na so dia Intirio Minista we bi  Mohamed Bazoum tok on Saturday.

Bazoum tok se dis terorist pipul bin atak N'Gagam vilej nia Niger boda wit Naija on Friday ivinin.

Urgence Diffa, we de tochlait  sekuriti and pipul kondishon fo di eria ripot se dis Boko Haram pipul bin land wit moto kom opun faya fo di polis pipul we de di vilej. 

Dem se plenti refugee dem de liv fo di vilej.

Bazoum bin go di vilej we de laik 40km from Diffa dat de wit im deligeshon bot smol taim afta dem don go na im dis Boko Haram pipul kom.

From taim to taim na im Boko Haram de waka from dia bez fo Naija go kil pipul fo Chad, Niger, and Cameroon.

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories