Di Prezident of Nigeria Football Coaches Association, Bitrus Bewarang tok se di kain "sudden death" we Naija koch dem de dai nawadez, i get as i bi o.
Bewarang tok dis wan afta im hie se bifo bifo Super Eagles Chif koch Amodu Shuaibu "suddenly" dai jos fiu dez afta anoda bifo bifo Super Eagles kaptin and kochii Stephen Keshi bin dai "suddenly" fo di sem Benin citi.
Bewarang kom tok se Naija koch dem de dai enihau bikos dia employas de du dem enihau.
"Wi stil de ask hau manej Keshi bin waka "suddenly", na im Amodu Shuaibu sef kom waka "suddenly" fo di sem Benin citi. Di kweshon nau bi se 'na hu bi di next pesin we go waka?'
"Taim don kom wen fedral govament go bigin tochlait mata we konsan koch dem fo Naija. Fo Naija, dem de sak koch dem enihau witaut peyin dem dia moni.
"Fo Naija, dem tu de owe koch moni. Ivun afta dem don sak koch, dem go stil de owe am. Dis kain tin, na im mek 75% of Naija koch dem de get haipatenshon."
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.