Sunday, June 2, 2019
Sunday, May 19, 2019
50% Of Abuja People Dey Shit For Public
Issorite! Nor be me talk am o. Na govament talk am.
Emmanuel Awe, wey be Director, Water Quality Control and Sanitation for Federal Ministry of Water Resources na im talk say 50 per cent of people wey dey live for Naija capital, Abuja dey shit for open place because dem nor see public toilet to use.
Awe talk say na wetin the National Bureau of Statistics and UNICEF on water, sanitation and hygiene (WASH) Norms tell am be that.
Awe been speak for the meeting wey Water Supply and Sanitation Collaborative Council (WSSCC) do with Head Teachers of Primary Schools for Federal Capital Territory, Abuja.
Saturday, May 11, 2019
Man Kill Wife Over Area One Palaver
According to Inspector Oladele Adebayo wey be prosecutor for the matter, Johnson bin want do smol jolly with him wife Deborah around 5.30 pm. Na so him carry two fingers come shuk inside Deborah area one, but the woman no gbadun dat kain thing at all at all. Na so fight come start o.
Like play like play, na so Deborah wey be 31 yiez old come die for her own husband hand o.
This badness bin hapun on March 21, 2019 arand 5.30pm for Adekoye Street, Igbo-Elerin, Ishashi, wey be say na dia dem dey live.
After him don listen to the prosecutor finish, Chief Magistrate O. O. Olatunji come order say Godspower go sidon for Ikoyi Prison, for the next 30 days wey be arand June 7. By that time, him go don receive advise from Lagos State Director of Public Prosecutions.
Tuesday, December 25, 2018
Xmas Wahala: Cow don kill pesin for Sapele
Yawa don gas for one butcher head for Sapele, Delta state. Wetin cause the wahala na Christmas cow o.
Naija languej hie say Wasiu, 27 yiez old bin carry one cow dey go abattoir on Monday, December 24. As the animal see say na abattoir the man wan carry am enter, fear come catch am o.
Na so the cow come tear race enter road dey find way to escape. Na so Wasiu sef begin pursue the cow o .
As im look back see say pesin dey pursue am, na so the cow match automatic break come pack Wasiu with im horn come nak am for grand two times.
Like say dat one nor do am , the cow come match the msn bele before im come tear race again.
Before pipul go arenj help come, Wasiu don waka join im ancestors.
Sunday, December 16, 2018
Na wa o! Woman with big chest just dey cause kasala fo Instagram
No be smol tin dey hapun fo Instagram now o, as men just dey run upandan to luk the piksho of one woman wey carry big big watermelon fo chest.
Confidence Adannaya Offor aka Creamy Dency dey sew clothes wey she dey sell for Instagram, but the big big bobi wey she carry don confuse men sotay even those wey no plan to buy her clothes just dey buy sake of say make dem get chance to try their luck with the woman.
We fo Naija Languej just dey wonder how she dey carry dat kain heavy load dey waka about. But then, our pipul talk say ikebe no dey heavy the owner.
Make una carry una eyes see wetin we sef see fo Instagram.
Sunday, July 29, 2018
Thursday, March 22, 2018
Wetin Boko Haram tel Dapchi pipul on Wednesday
Boko Haram don giv serious warning to Dapchi pipul mek dem no eva try to send dia girls to skul again.
On Wednesday, na im Albarnawi and im boys fo Boko Haram giv dis warning as dem kom return arand 100 skul girls wey dem kidnap last month.
Sekuruti pipul bin ful grand fo Dapchi vilej insaid Yobe stet on Wednesday wit Non-Governmental Organisation, NGO pipul dem plos dem papa and mama and family memba of di skul girls di time wen Boko Haram bin bring dem back arand 8 o'clock in di morin.
Na im Boko Haram kom tel dem say wetin dem sopoz to do fo di girls na to find husband fo dem as dem don reach to born pikin.
Luk piksho fo onda.