Bifo bifo president dem, Olusegun Obasanjo, and Goodluck Jonathan don join bodi go mit President Muhammadu Buhari fo Aso Rock Villa.
I neva tey wey Oga Jona riton from di waka wey im waka go United States of America, United Kingdom and Cote D'ivoire bifo Baba Buhari kol am mek im kom Villa mek dem tochlait som mata.
Naija Language hie se na Obasanjo arenj di mitin o.
I bi laik se na di wahala wey Niger Delta Avengers, NDA dey kos fo eria na im dem tochlait o..
Dis NDA pipul don skata paiplain sotey Naija dey loss som billion dollars evride fo oyel moni.

0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.