Friday, June 3, 2016

NFF wokas poshu Giwa and im agbero fo Glass House

No bi smol tin bin hapun yestade fo Glass House o as bifo bifo chiaman fo Naija Football Federation, NFF wey bi Chris Giwa kari som agbero go brek ofis door as im won tek ova di ples bai fos.

As NFF staf kom de poshu Giwa and im pipul, na im kasala bost o as di 2 grup kom dey fait demsef.

Pipul wey kari dia aiz si wetin hapun tok se doz Giwa im agbero bin sho Christian Emeruwa, (National Security Officer fo NFF), Tunde Aderibigbe, NFF’s Coordinator on Political Matters fo NFF) and Ademola Olajire ( Head of Communications fo NFF) pepe o.

Dem se som of di pipul wey folo Giwa go du dis badness fo NFF ofis na Effiong Johnson, Sani Fema, Rumson Baribote, Ben Agary, Yahaya Adama, Jide Fashikun, Fatai Olayinka, and Abdulazeez Mohammed.

Na afta Police kom enta di mata na im tins kom setul daun fo di ples.

Si di door wey Giwa im boys bin brek fo Glass House.

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories