Ben Alamar wey bi Director of Sports Analytics fo ESPN na im komot wan list on Tuesday wey kari di nem of 100 sportmen wey bi se na dem famous pas fo di world.
Alamar say im kari di salary wey di sportmen dey kolekt wit dia endorsement moni kom join di nomba of pipul wey dey folo dem fo social media wit hau pipul dey search dia nem fo Google.
Afta im don join ol dis tins, na im Alamar kom get di list wey im kol "the ESPN World Fame 100 rankings.”
Insaid dat list, na di top 10 bi dis.
1. Cristiano Ronaldo
2. LeBron James
3. Lionel Messi
4. Neymar
5. Roger Federer
6. Kevin Durant
7. Tiger Woods
8. Virat Kohli
9. James Rodriguez
10. Rafael Nadal.

0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.