Saturday, May 28, 2016

Penariti na kalo kalo - Ronaldo

Cristiano Ronaldo wey bi se na im sko the last penariti wey Real Madrid tek win Champions League as dem flog Athletico Madrid 5 - 3 fo Milan don tok se penariti na kalo kalo.

"Penariti na kalo kalo. Yu nor go nou wetin fit hapun. Bot wi kom sho se na wi sabi tap futbol pas. Ivun dou na penariti wi kari win, na beta nait bi dis wey awa bele swit no bi smol. "

Na so Ronaldo wey dem dey olso kol CR7 kom tel BT Sport after Real Madrid don kari di Champions League.

Afta Athletico pleya wey bi Juanfran don trowey im oun penariti na im Ronaldo kom kul tempa kom tap im oun insaid net.

Na so Los Blancos tek kari Champions League o. And na 11 taims wey dem dey win am bi dis o.

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories