Economic and Financial Crimes Commission, EFCC say i no ivun rish 6 mont we Ayodele Fayose bikom govano of Ekiti Stet bifo im komot N1.35b from poblik moni go bai 6 haus fo imsef.
Dem say Fayose bai 4 haus fo Lagos and 2 fo Abuja.
Akodin to EFCC, Fayose bin haid fo di bak of im sista Moji Ladeji and im frend we bi Abiodun Agbele bai ol dis haus.
EFCC tok se di 2 Abuja haus de fo nomba 44, Osun Crescent and nomba 32, Yedseram Street, Maitama. Dem say di Lagos haus na nomba 3, 4, 6, and 9 insaid Plot 100, Tiamiyu Savage Street, Victoria Island, Lagos.
Si wetin EFCC mak fo di haus dem.

0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.