Sunday, July 17, 2016

Notin konsan govament wit agrikolsho - OBJ

Naija Prezident bifo, Olusegun Obasanjo don tok se govament no sopoz to de put hand fo agrikolsho biznes bikos pipul don ton am to paip we dem de yuz saifon poblik moni.

Obasanjo bin tok fo University of Ibadan on Saturday fo won program we dem taitul “Agribusiness: Time to act.” Im say taim don kom fo famas and govament to put swaga fo agrikolsho so dat yong pipul go join di biznes.

OBJ bin tok as gest lekshora fo di 1st edishon of di Eminent Persons Business Lecture of di University of Ibadan School of Business, UISB in join bodi wit  International Institute of Tropical Agriculture, IITA, Ibadan.

“Na tru se govament no fit komot hand kpatakpata fo agrikolsho, bot na onli sopot im sopoz to giv di pipul we de fam. Bot to say mek govament stil de shuk hand insaid agrikolsho, dat won no go wok.

“If yu si wia govament de du agrikolsho, na to yuz am to tif moni.

"A don si wia stet govament biuld poltri wit smol smol chikin insaid bot fawul shit no de dia. Ivun doti sef no de di poltri. Komon wota no drop fo graund. Di ples kom klin laik se no bi fawul de ste dia. Di govano of dat stet dizain di poltri as wetin im go de yuz chop govament moni. Dat kain tin no sopoz to kontiniu."

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories