Ese Oruru, dat 14 years old skul girl wey Yunusa Dahiru wey dem dey olso kol "Yellow" bin kidnap kari go Kano don born baby girl o.
Araund 10 o'clock in di moning na im dem tok say Ese born di pikin fo Government House Clinic fo Yenagoa.
Ese papa wey bi Charles Oruru kom tok se im bele swit as im dota born di pikin witaut eni wahala.
"Yes o, mai dota born dis moning araund afta 10. Mama and pikin dey kampe. Shi born di pikin (baby girl) bai hasef. Wi hapi se born witaut eni wahala." Na im tel nius tori pipul.
As i bi, Dahiru wey giv Ese di bele stil dey prizin as im nor fit mit di bail kondishon wey judge giv am.
See di fain pikin wey Ese born fo dis piksho.

0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.