Wednesday, June 29, 2016

Welkom to First Cannabis Church of Logic and Reason

First Cannabis Church of Logic and Reason. Na di niu choch we dem opun fo Michigan, United States of America.

Fo Naija lingo, yu fit kol am Indian hemp ou Igbo choch of shain yo aiz and rizin.

On Sunday, June 26, 2016 na im dis choch bin du dia fest savis.

Hie wetin di jenaral ovasiya of di First Cannabis Church of Logic and Reason we bi 34 yiez old Jeremy Hall bin tok on Sunday.

“Wetin a wn achiv na to provaid ples wia pipul fit join spirishual tins wit oda medisin we fit jinja dia bodi."

Hall tok se dis im choch no bi laik oda choch dem bikos insaid Cannabis Church, Marijuana na pat of woship ou relijos ekspiriens.

“Igbo de komot pen fo bodi and i de mek pesin fil se im tu folo bilong. Igbo na somtin we de klia pesin hed, kom ful im heart wit enof lov."

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories