Tuesday, July 19, 2016

Lovaboi ron liv hotel afta im girlfrend dai dia

Polis fo Lagos de sach fo won man we dem sospekt se im kil im girlfrend insaid won hotel fo Ikotun eria.

Naija Languej hie se di man bin pe moni fo 1 awa so dat im go hav nais taim wit im wuman.

Araund 9.30 on Friday nait na im di man go loj fo Tala Hotel wit im girlfrend. Na im bi se na araund 10.30 dat nait di moni we im pe sopoz to espaya.

Araund 10 pm, di man tel di hotel pipul se im wn go bai somtin ausaid. Bot dem no nou se na di aidia we im wn tek klia from di ples bi dat.

Na bai 12 midnait wen di manija go di rum to shek wai di gest de du ova taim, im si se di wuman don dai and di man don klia from di hotel.

Di manija we im nem bi Ahmadu tok say im go ripot di mata fo Ikotun polis steshon bifo polis kom kari di ded bodi put fo moshuari.

Polis Public Relations Officer fo Lagos Stet, Dolapo Badmos konfam di stori.

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories