Sunday, July 17, 2016

Kopul sel dia pikin to bai iPhone fo China

Won man and wuman we born pikin togeda fo China don sel dia 18 dez old bebi to sombodi we dem mit fo intanet jos to get moni to bai niu iPhone.

Di man we im nem bi A Duan tok say im bin get di pesin we bai im dota wen im de chat fo intanet.

People's Daily Online tok say di 19 yiez old yong kopul bin get bele bai mistek, kom de strogul fo moni.

Di mama of di pikin, Xiao Mei say shi no nou se na bad tin to sel pikin bikos ivun hasef na prodokt of adopshon.

Ouredi, court don send di kopul to prizin. A Duan go spend 3 yiez dia bot na onli 21/2 yiez Xiao Mei go spend.

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories