Friday, May 27, 2016

Minista don sak Oga Chairman fo AEPB

No bi smol tin bin hapun fo AEPB wey bi Abuja Environmental Protection Board dis week o, as Minista wey dey kontrol FCT, wey im nem na Mallam Mohammed Bello don komot Oga Chairman fo AEPB, Baba Shehu Lawan fo office.

Di minista kom tok say mek dem kari Madam Omolola Oluwatoyin Olanipekun put fo di chair wey di oga bifo bifo from komot.

Oga Bello nor stop dia as im kom remove ol di head of dipatment and yunit dem, kom kari dia deputi dem put fo dia posishon.

Na afta di minista do one mitin wit Permanent Secretary fo FCT and bifo bifo AEPB manejment im kom kari brum sweep ol dis pipul komot.

Bello kom tel di Direkto wey dey run tins fo Establishment and Training fo FCT mek im gjv apointment leta to di niu pipul wey jos tek ova.

As di minista do dat one finish, im kom warn ol di pipul wey dey wok fo AEPB say mek dem dey sirios wit dia wok as im no wan see beggars dem, pipul wey dey sel maket fo strit ou ivun doti fo Abuja again.

As Bello kom sak dis pipul finish, im kom give dem anoda wok wey bi say dem go go kolekt ol di N9.8b wey som pipul dey owe AEPB fo Abuja.

Im kom tok say im giv dem onli 2 months to kolekt di moni kom put am fo AEPB account fo bank.

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories